some get head but them no get sense
some get mouth but them no fit to shout
some get eyes but them no fit to see
some get leg to walka but for that same walka them get hit by a car
you just never know wetin life go fling to you
never let the voice of defeat to sing to you
continue to do wetin you sabi do
cause some people dey craze
i dey see them from far away
now tell me who's to blame
and my guy tell me wetin you see
a person like you wey dey put head like you
or a stranger because of the thing i believe
na one love religion i belong to
never let the voice of defeat sing to you
continue to do wetin you sabi do
cause some people dey craze
i dey see them from far away
now tell me who's to blame
and try to focus on the ties that binds us together
than the differences that separate us my brother