help me spread this message like globacom
make nobody come here dey come dey form
i know say no be everybody follow come
and no be every breast wey be silicon
make dem no come dey wash you
and make you do exactly what you wan do
make you no say i no tell you
make you no let devil come dey use you
but if i tell you say i love you
abeg abeg no go turn me to your mugu
and if i start to dey stress you
let me know because i no want to vex you
the same time you go do wetin wey favour you
so make we do de thing jeje
so just be living ur life and do de thing jeje
come dey form like butter
because i know say you know say i know you
and no be every dressing go fit you
make you no make me mara eh
attentiveness for my matter eh
na me and you dem talk about
and if i tell you say i like you
abeg no let shakara come dey kill you
and if i start to dey stress you
let me know because i no want to vex you
the same time you go do wetin wey favour you
so make we do de thing jeje
so just be living ur life and do de thing jeje
so make we do de thing jeje
so just be living ur life and do de thing jeje
make you dey check yourself
before you come dey do wetin go cast you
cause i don try for your matter
make you no dey do pass you
cause i go do my own and you go do your own
anything wey remain na bone we go bone
cause life is too short for debating
so make we do de thing jeje
so just be living ur life and do de thing jeje